ReviewEssays.com - Term Papers, Book Reports, Research Papers and College Essays
Search

One Big Strom

Essay by   •  February 13, 2011  •  Research Paper  •  12,355 Words (50 Pages)  •  3,743 Views

Essay Preview: One Big Strom

Report this essay
Page 1 of 50

WAKA DEM WEY JONATAN GULLIBLE WAKA.

NA KEN SCHOOLLAND WRITE AM

NA AGWU AMOGU PUT AM FOR PIDGIN ENGLISH.

Chapter 1 - One big Storm

For one town wey dey near river and wey sun dey shine well well, one man wey dey answer Jonathan Gullible don already dey live there before people wey carry motor wey no get cover and wey den be ogbonge actors come begin live there.

Everybody see this man as person wey no get head, but him papa & mama no see am so, dem think of am as person wey im sense complete, wey dey always talk true and say im go fit do sport well well. Dem dey work for one shop wey dem dey sell things wey den dey use for ship to take catch fish, for the main street of one twin wey na people wey dey catch fish boku for there - for the town dem get some people wey dey hardworking, some of these people bad, some dey good and many inside them just dey plain small.

If Jonathan no get message to send or work to do for im family store, im go carry im jagajaga sailing boat play go. Like many other young people, Jonathan see say im life no to sweet and say the people for im area no too tap. Im dey always want see one big ship or water snake any time im dey drive im boat. Im even dey think say one day im go jam people wey go kidnap am for on top water and carry am travel all the whole 7 rivers by force, or person wey dey catch whale go carry am go hunt for whale. Most of these im strowe dey stop when im belle begin shout for food or when im throat dry for water.

For one sunny day like that wey the sea fine and coole well well, Jonathan no even think of im afternoon food or even the things wey im dey use catch fish, im just rush carry boat enter sea go. Im no even take note of the heavy and dark clouds wey gather for front.

Jonathan never too go far, and im mind coole well well. The time wey the wind begin blow well, im no even worry at all until e dey too late. E no to tay before im begin dey struggle with to survive as the breeze dey blow im boat here and there. Everything wey im do to rescue imself dey useless because the breeze too many and e just they blow im boat inside water like say e no get weight at all. At last Jonathan lie down flat for the ground of the boat, im even hold the sides of the boat and pray to God say make im boat no tumble inside water. E no too tay before morning reach.

When the heavy breeze stop to blow, im boat don already scatter - scatter. The sea cool down but im no fit se clearly because every where still dey dark. Im dey on-top water for days and im no fit control im boat. To add salt to injury im drinking water come finish. At last the whole place come clear, na then im come see one small land wey dey surrounded by ater. Close to this land im see small hills and plenty snd-sand and also some plants wey dey grow.

As the water carry am near the land, im jump comot from im scatter-scatter boat come begin swim quick - quick to the land sharp-sharp im don see and chop guava; ripe bananna and other many delicious fruit wey booka for the place. As soon as im get some power, Jonathan come begin dey feel lonely but at the same time im thank God say im still dey alive. True-true im come even dey happy as im cme get many time to play. No do-no do im don begin search to discover more above this place wey im just find out.

Chapter 2 - Kata - Kata People

Jonathan waka for many hours and e no see any sign of life. No do-no do, something move inside bush and one small animal wey get yellow - yellow line for im tail run follow one road wey bush full. Jonathan think say na cat and say may be e go fit follow am to see whether other animals still dey the land.

After im don comot from sand - sand area enter inside thick bush, im hear one big shout. As im stop to try know where the sound dey come from, na so im hear somebody dey cry for help. Im come begin look for way to go forward before im come see one road wey big pass the one wey im been dey.

As im corner for one sharp corner, na so Jonathan jam one fat man. The man shout, "comot for my road!" im even push am comot like say im be small fly. Jonathan dey very surprised but as im look up, im see two men wey dey drag one woman, wey dey struggle with them, dey go. By the time wey Jonathan sense correct, the three of them don vanish, im no say im alone no go fit save the women, na so im run follow where them from dey come with the mind say im go see people to help am.

For one open space im see some people wey gather round oen tree dey use big-big sticks dey tae wipe the tree. Quick-quick Jonathan run go meet one man wey look like the supervisor. "Pls sir, helep me!" na so Jonathan dey breathe like person wey run marathon. "Two men do catch and carry one woman wey go and e go good if we helep am!".

"If na dat one, you no go worry at all because the woman dey under arrest", na so the man answer Jonathan like say wahala no dey. Again Jonathan dey surprised because the woman no like criminal and say even if the woman dey guilty why she come dey hala for help? Jonathan come ask the man, "abeg sir, na wetin she do?" The man bi no want answer bcos im don begin vex, but im come tel Jonathan say the woman dey cause kata-kata for all of them wey dey work there. Jonathan no understand wetint he man they talk im con still ask am say how the woman take dey cause kata-kata for people wey dey work for there. The supervisor look Jonathan one kain, im come tell am to follow am go one tree side where workers dey work. The man come tell am say, "all of us na tree workers. For sake of wood we dey fall trees down by using these stick to take hammer the tress. For sometimes, one hundred people wey work from morning till night go fit fall one bug tree before one month." The man stop to talk and im clean the dirty wey dey the hand of im coat.

Im continue to talk, "that wahala woman wey dem dey call Drawbaugh come work this morning, with one sharp iron wey she tie join the ending of her stick-she fall one tree down under one hour - by herself! Think am! Shey that kain thing good, make one person come dey threaten our tradition of how we dey work. That is why we must to stop her on time before e too late.

Jonathan eyes open well-well. E no believe say this woman dey suffer punishment because she get sense. From the place im from come, everybody dey use axe and saw to take cut wood. Na so im even take get the wood wey e take build im boat. Na im Jonathan summon courage, im come shout say, "but the thing this woman do go allow everybody

...

...

Download as:   txt (60.8 Kb)   pdf (576.6 Kb)   docx (37 Kb)  
Continue for 49 more pages »
Only available on ReviewEssays.com
Citation Generator

(2011, 02). One Big Strom. ReviewEssays.com. Retrieved 02, 2011, from https://www.reviewessays.com/essay/One-Big-Strom/37863.html

"One Big Strom" ReviewEssays.com. 02 2011. 2011. 02 2011 <https://www.reviewessays.com/essay/One-Big-Strom/37863.html>.

"One Big Strom." ReviewEssays.com. ReviewEssays.com, 02 2011. Web. 02 2011. <https://www.reviewessays.com/essay/One-Big-Strom/37863.html>.

"One Big Strom." ReviewEssays.com. 02, 2011. Accessed 02, 2011. https://www.reviewessays.com/essay/One-Big-Strom/37863.html.